
One foundation for Kwara state wey dey give education belle, Sunday Babalola Foundation don give 250 pupils/ students for one local Government for d state wey dem dey call Irepodun. As e dey talk for d 2nd edition of how dem wan give d scholarship to pipu wey win am for Omu-Aran on Thursday, d person wey get d foundationEngineer Sunday Babalola talk say na up to 140 students wey be indigene and wey be secondary school pikin, polytechnic and University students for Omu-Aran town, na dem enjoy d scholarship thing last year.
Engineer Babalola wey talk am say d mukumukeke of d scholarship don dey enter oda town wey dey d local government for this new edition, say na hin make d numba od pipu wey go enjoy d scholarship increase from 140 wey e bin dey to 250 wey e com be now. D donor com talk am say no be say e wan carry any political post, say he only dey try dey adrress issue of hardship, poverty, unemployment and crime for d area.
Babalola wey wan contest for d post of Governor for d state talkam say na hin own way of contributing to wellbeing of society and development of citizens of hin state, as he talk am. He com call on d state government, cooperate organisations and individuals say make dem encourage education.
Okegbemi Olusoji Festus is an Editor/Creative writer at campustori.com, A digital media Executive and a known Social Media Enthusiast.
Leave a Reply